Churches resume in Lagos State

Nigeria goment bin suspend religious gatherings for kontri since March to curb di spread of di virus.
Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri for June but di Lagos State goment no gree allow worship centres for di state to reopen sake of di increase in coronavirus cases.
Dem later give go ahead for religious gathering to start on 7 August.
But some churches for di state don come out to say dem neva ready to reopen.
Di churches get different reasons for dia decisions, some say na to prepare di place for reopening wey go meet di safety protocols of di federal goment, others say dem dey wait to hear from God before dem reopen.
See di list of some churches wey no go open for 9 August:
MOUNTAIN OF FIRE AND MIRACLE MINISTRIES
Di leadership of Mountain and Fire and Miracle Ministries MFM tok say pipo no go gada together for service for all dia church regions, branches or zones wey dey Lagos and Ogun states until 13 September 2020 as dem wan put in place preventive measures against coronavirus and follow all di safety protocols wey federal goment, state goment and NCDC put for ground.

WIA DIS FOTO COME FROM,DANIEL OLUKOYA/FACEBOOK
Daniel Olukoya na di Senior Pastor of Mountain of Fire And Miracle Ministries